• Home
  • Weird Story
  • This African King Has 15 Wives, Performs Marriage Every Year

This African King Has 15 Wives, Performs Marriage Every Year

By: Pinki Sun, 12 July 2020 9:48:33

This African King Has 15 Wives, Performs Marriage Every Year

Mswati III, King of Swaziland get 15 wives and 30 pikin dem. Tradition for im kingdom allow am to marry new wife every year.

Mswati na di king wey recently change im kontri name from Swaziland to eSwatini.

Mswati III, real name na Makhosetive Dlamini, wey mean "King of Nations".

Every year, im dey host annual Swazi and Zulu traditional dance festival wey dem dey call Umhlanga Reed Dance; and from dia im go choose new wife from among di young girls wey follow do di dance festival. Dem done accuse am many times say im dey kidnap young women wey im desire to marry. Last year im marry im latest bride Ms Siphelele Mashwama wey bin dey 19 years.

african king has 15 wives,mswati iii,king of swaziland,weird news

Tori be say, for 2011, im pursue wife number twelve because she go 'play ball' with anoda man wey be minister of justice for di kontri.

King Mswati wife number eight commit suicide for April 2018.King Mswati papa wey be King Sobhuza II bin marry 125 wives come get about 300 children. Im bin die wen im dey 82 years.

Wen im papa die, Mswati bin dey 14 years, two of im papa wives ((Queen Dzeliwe Shongwe, and Queen Ntombi Tfwala) occupy di throne till Mswati reach 18 years to take over di throne.

african king has 15 wives,mswati iii,king of swaziland,weird news

Mswati come become king for 1986 wen im reach 18 years, now im dey 50 years.

Pipo dey accuse am say, im dey waste moni for tins wey no mata wen im kontri pipo dey suffer.

Over 61% of pipo for Swaziland dey survive with less dan $1 per day but dia king bin allocate $61 million for im house keeping for 2014.

For inside Forbes 2009 list of kings wey get moni pass for world, King Mswati worth about $200 million.

About Us | Contact | Disclaimer| Privacy Policy

| | |

Copyright © 2024 lifeberrys.com